Drama for road as one Nigerian man wey buy Dangote Refinery shares don declare himself co-owner of all Dangote trucks.
In a viral video wey Arise News carry for "What's Trending" yesterday, the man was seen for highway dey touch Dangote truck dey shout "Na our car be this ooo! It's our car!"
The video don scatter internet as thousands of Nigerians wey also buy shares don join the cruise.
Reports say after Dangote Petroleum Refinery launch IPO this week, many Nigerians rush buy shares from ₦5,000 to ₦100,000. Now everybody dey claim partnership with Aliko Dangote.
Popular cartoonist Joshua Nyong even draw cartoon of Dangote confronting one small investor wey say "Oga, na our refinery be this."
For X (Twitter), Nigerians no dey gree:
"Dear Dangote, as a shareholder in OUR refinery, I want to suggest..."
"If Dangote driver overtake me for road, I go arrest am. I be co-owner."
"Abeg rename am to WEGOTE Refinery."
Burna Boy song "Dangote" don even become anthem for the movement.
How much you take buy your own Dangote share? You don stop Dangote truck before? Drop for comment section.
TAGS: Dangote IPO, Dangote Refinery Shares, Dangote Truck Video, Aliko Dangote, Viral News
Wahala 😂 This man buy ₦52k Dangote shares don turn owner of Dangote trucks for road!
"Na our car be this ooo"
How much YOU buy?


No comments:
Post a Comment